Tech Career Wahala: The Awakening
Ashabi:Motun o! I no go lie, I dey para! 😤 Since morning, I don watch like 15 YouTube videos. One say learn data science, another one shout blockchain. One even carry big grammar like "quantum cloud devops engineering"—abeg wetin be all these! 😩
Motun:😂😂 Ashabi! Calm down! Na so tech wahala be. If you no hold compass, you fit waka inside forest for 9 years like Moses.
Ashabi:You dey yarn! But truth be say, I no sabi where to start. Na developer I wan be? Or UX designer? Abi make I dey build robot wey dey cook egusi?
Motun:See ehn, you just remind me of my own tech baptism. Back in 2012, na KarROX I dey do Cisco wey no dey sweet me. I jump enter IT at Gateway, still no click. I no even know say wetin dey burn me inside na software engineering. No YouTube o, no mentor, no laptop sef. Just raw fire and small NEPA light. 🔌
Ashabi:Motun! You suffer o! But now you dey shine like new generator. How you come sabi your path?
Motun:Na one data science class wey I enter for 2021 gimme the “lightbulb moment.” I realize say na code I dey find all these years. Since then, na build I dey build. But the koko be this: I no want make people suffer like I suffer. That na why I create one small corner for my website — www.motunmarteen.tech/career-quiz.
Ashabi:Wait fess! You get quiz? Like JAMB but for tech?
Motun:No be that kind wahala quiz o 😅. Just honest questions to understand your brain wiring, wetin you enjoy, how you reason, and which tech lane go sweet your spirit. After that, the thing go suggest career paths like frontend, backend, UI/UX, cybersecurity, Web3 and even give you links — both free and paid — wey go guide you straight.
Ashabi:Omooooo! Na spiritual compass you build be that! 🔥
Ashabi:But Motun, how person go sabi say na coding sure pass for am?
Motun:E easy. I go break am down. Imagine say tech na restaurant. Each person get their role, for instance:
- Frontend Dev na the waiter wey dey serve food with style, make sure everything look fine for customer eye.
- Backend Dev na the chef for kitchen, dey cook all the food wey dey make customer happy.
- UI/UX designers na the interior decorator wey arrange the restaurant, make everywhere fine and easy to waka.
- Product managers na the restaurant manager wey dey plan menu, dey check how customers dey enjoy their food.
- Product Marketers na the marketer wey dey shout for street, dey tell people say this restaurant dey serve correct food.
- Cybersecurity guys na the bouncer for door, no let thief enter or carry food run.
- Data scientists na the accountant wey dey check how many plates dem serve, which food people like pass.
- DevOps na the logistics manager wey dey make sure everything dey run smoothly, from kitchen to customer.
So, na to find which role fit your vibe for the restaurant. But remember say plenty tech career dey wey I no mention. Na why I create the quiz to help you find your own tech role.
Ashabi:Wahala for who no sabi cook o! So how I go take choose?
Motun:That’s why I create the quiz. Me wey talk to you so, I waka 9 years before I land. But now? I dey give una shortcut. Answer few questions and get clarity sharp-sharp.
Ashabi:If I never touch code before, I fit still enter tech?
Motun:Who born code? 🤣 Na somewhere Everybody dey start. Many tech roles no even need code to start. E fit be UI/UX or product management. Later, if code dey call you, you go answer.
Ashabi:I dey fear math o. E go affect me?
Motun:No fear jare. Some areas need more logic than maths. Backend like small math, but na logic sure pass. Design, product, QA, them no send calculus.
Ashabi:If I get full-time job, I fit still enter tech?
Motun:Yes na! Learn part-time. Even weekend. Even midnight. Just dey consistent.
Ashabi:Abeg, I like money. Which career dey pay pass?
Motun:😂 Ashabi! Na skills dey attract money, no be title. But roles like DevOps, backend, AI, and blockchain dey burst bank accounts. Just make sure say you sabi the work wella.
Ashabi:I be woman o. Dem dey do women for tech?
Motun:Na everybody tech epp ooo 🙅🏽♂️ Na brain matter, no be gender. Plenty tech babes dey burst brains — see Ada Nduka Oyom, Ire Aderinokun… You sef fit boss the space.
Ashabi:As Motun don yarn, this tech thing na like Lagos market — e full options. But make person no dey waka round like headless chicken. That quiz go help me sabi which path my destiny dey find. No more confusion! Oya make I go answer the questions before NEPA do their usual magic. ⚡️😅
Ashabi:Visit www.motunmarteen.tech/career-quiz and take the quiz. Then, write down the three tech roles that match your vibe. Share with Motun on Instagram or X and use hashtag #TechWahalaSeries.