Back to Blog

The Future of A.I. in Everyday Applications

Artificial Intelligence | by Marteen Motun Mubaraq

Ashabi:Motun o! 😤 This morning my alarm shout, “Time to wake up, babe!” Na AI I set or na spirit dey talk to me?

Motun:😂😂 Ashabi, no be spirit. Na AI dey romance your life lowkey. From that alarm voice wey sweet pass sugar to the way your phone sabi your movement — AI don jam us gbagam.

Ashabi:You no go believe! My Google Maps dey even know say na Mama Uju’s shop I dey go every Friday. Wetin dey happen abeg? This thing dey sweet and dey fear me at the same time.

Motun:No panic. AI na like agbaya wey sabi. E dey learn from how you dey use your phone, your apps, your wahala. E dey collect data small-small, like tithe, then use am do magic.

Ashabi:So all this AI talk — e no be just for robot wey dey dance for Instagram?

Motun:Far from am! AI dey inside your phone keyboard when you dey type “I’m…” and e complete “coming.” E dey Netflix when e suggest say, “Because you watched King of Boys…” E even dey inside bank app when dem flag fake alert from those WhatsApp Yahoo boys. 😂

Ashabi:Wetin be the koko difference between normal app and AI app?

Motun:Normal app na like okada wey follow straight road. But AI app be like Uber wey sabi traffic, weather, and your mood. AI dey adapt. E dey reason. E dey predict. Sometimes, e even dey try get sense pass you but no be me talk am ooo. 😅

Ashabi:So developers like una dey add this thing inside code?

Motun:Yes na! For example, imagine we dey build app wey dey recommend jollof recipes:

1import random 2 3user_preferences = ['spicy', 'meat', 'party'] 4recipe_db = { 5 'jollof_rice': ['spicy', 'party', 'tomato'], 6 'coconut_rice': ['mild', 'seafood'], 7 'fried_rice': ['meat', 'veggies'] 8} 9 10def recommend_recipe(prefs): 11 for recipe, tags in recipe_db.items(): 12 if any(tag in prefs for tag in tags): 13 return f"How about trying {recipe} today?" 14 return "Just chop bread and groundnut jare!" 15 16print(recommend_recipe(user_preferences))

Ashabi:Ehn ehn! So na like matching person preference with wetin dey available. Smart o!

Motun:Yes. And with real AI, e dey learn over time. If you reject coconut rice today, tomorrow e no go show you again.

Ashabi:So AI dey inside Instagram filters too?

Motun:Correct! Na AI dey shape your nose and turn you into cat. Even remove pimple. 😹

Ashabi:All these AI features dey collect my data?

Motun:True talk. Dem dey collect data, but good apps dey protect am. Still, shine your eye. Read privacy policies. No just dey click “Accept” like sey you dey sign NEPA slip.

Ashabi:How developers dey start to learn AI?

Motun:Start with Python. Then learn machine learning small-small with libraries like TensorFlow, scikit-learn, or even use chatbots. Free courses dey everywhere!

Ashabi:Na only big companies fit use AI?

Motun:Mbanu! Even you fit build WhatsApp bot with small AI inside. No be by size, na by sense and access to good data.

Ashabi:I wan enter tech, AI sweet me. Which role fit me?

Motun:E depend. If you sabi maths and like prediction, try machine learning. If you sabi design chatbot flow like parlor gist, try conversational AI. If you just like wahala, try data engineering. 😆

Ashabi:So AI no be alien from Mars. Na the thing wey dey help me choose my jollof level, arrange movie list, and block Yahoo boys. As Motun don explain, e dey everywhere like pepper for Nigerian stew. E no just dey beautify life — e dey sabi pass! Omo, I dey ginger to build my own AI app sharp-sharp!

Ashabi:Pick any app wey you dey use everyday — like YouTube, TikTok, or Uber. Write 3 ways wey AI dey power am. Then try imagine one local Nigerian problem you fit solve using AI. Write am down and gist with person about am.

Tags:

AIFuture of TechLarge Language ModelsHumorEveryday TechAppsArtificial Intelligence